Tennis smallie player wey be Coco Gauff don fall hand comot for the first round for Luxembourg Open just days after she kolobi her first WTA title.
American world number 71 wey be Gauff, 15, chop am 6-4 6-0 for the hand of Russian eighth seed wey be Anna Blinkova for just 59 minutes.
Gauff become the youngest player wey go kpake WTA title in 15 years when she kpokpo b4 b4 French Open champion Jelena Ostapenko for the Linz Open final.
Gauff and compatriot Caty McNally dey for the women’s doubles quarter-finals.