Presido of the Nigeria Football Federation, Mr. Amaju Melvin Pinnick tok say the football governing join body go soon institute welfare foundation for before before Naija international players dem to take make sure say kpogiri dey on ground for them in case of unexpected health challenges as e take happen n with Chairmo Christian Chukwu.
Na both the NFF presido and the 1st Vice Presido of the Confederation of African Football, give dis assurance for inside London.
For the NFF Football Awards for Lagos on 1st April 2019 naim dem announce say dem go form welfare foundation for we football legends dem to take care of them wen dem dey in time of need.
As at the time wey dem yarn dis one dem no even think am say Chairman Chukwu go get dis kine health challenge.
But Presido Amaju say im happy say dem bin fit make better arrangee for im surgery, medication and general after-surgery care and say by the time e go come back naija, e go dey hale, hearty and sound of mind and body.