Tori say World Rugby don refer the Scottish Rugby Union to their disciplinary committee over wetin chief executive Mark Dodson bin tok for the build-up to the World Cup kasala against Japan.
The match for no hold at all sake of Typhoon Hagibis and dem for cancel and comot Scotland for setting if to say e no shele for Yokohama on Sunday.
Dodson don come out to tarsis World Rugby “rigidity” and e bin hint say dem go take legal action.The game later shele and Scotland fall hand 28-21 to carry waka comot for the group stage.