Boxer Oleksandr Usyk first bout for the heavyweight division don enter on chance after Saturday opponent Tyrone Spong bin return an adverse doping test meaning say dem bin find some kine prohibited substances for im system na so promoter Eddie Hearn.
Usyk, 32, bin kolobi all four world titles wey dey for cruiserweight and people bin dey expect am to move up one division.But Surinamese-Dutch fighter Spong position no sure again after Voluntary Anti-Doping Association (Vada)test am.