United States Don carry better shock give France for the Under-20 World Cup wey dey shele for inside Poland.
The French try overcome the early goal wey U.S been score but Tab Ramos side come score two late goals wey come helep dem enter last-16.
Everybody surprise as the United States take shock France wey many dey expect to win the tournament. Dem samma France 3-2 akpako to take continue their Waka for Poland.
Justin Rennicks bin take advantage of the way wey France goalkeeper, Alban Lafont, no fit hold ball to take score the winner for the 83rd minute and give the United States hope to continue for the tournament. Dem bin dey 2-1 behind for the second-half.
Dis kimono against France now don helep the Americans move enter the Under-20 World Cup quarterfinals for the third straight tournament, and now den go play Ecuador on Saturday.
The Americans bin start Ledezma and Paxton Pomykal sake of say starting midfielders Alex Mendez and Chris Durkin bin dey suspension and dem no dissapoint at all as Ledezma set up the first goal of the match with Soto opener.
Now the United States to dey hope to reach the U-20 World Cup semifinals for the first time since 1989, when dem bin finish fourth.