Dem bin subjest Sampdoria and England under-21 international player wey be Ronaldo Vieira to racist abuse for one Serie A clash with Roma.
The kasala shele when the two sides bin play goalless draw and e come see the 21-year-old become the target of monkey chants from the Roma supporters wey travel come.
Since then Roma don sharperly enter social media go tweet apology give the youngster and dem tok say dem no dey tolerate any form of racial behaviour’ and say dem go work hand in hand with authorities dem to carry identify and after that one ban anybody wey dem find guilty.