Aproko from inside Germany tok say more than 135 tennis players, including one player wey dem rank for the ATP top 30, don implicate for one international betting scandal.
According to joint tori by daily newspaper Die Welt and broadcaster ZDF, the players dey subject to cross-border shook eyes wey go involve both the FBI and European authorities dem.
The tori say among the people wey dem say get hand inside na one male player wey dey the top 30 wey don kolobi three ATP tour titles.
Dem say the scandal involves hundreds of small bets ontop games wey dem fix wey come wrack up profits wey reach tens of thousands of euros for each case.