Pay or face transfer ban – FIFA tells Cardiff City

Tori say Cardiff City go face three-window transfer ban if dem no gree pay Nantes the first instalment of the £15m fee for striker Emiliano Sala.

Sala bin kpuff for inside plane crash for January when e bin dey travel from France to go join im chacha club. Fifa don release the full reasons for their September ruling wey command Cardiff to pay the first 6m euros (£5.3m).

Cardiff go waka go the Court of Arbitration for Sport go lodge appeal against the decision in the next two weeks.

The Championship club dey argue say dem no dey liable for any of the kpogiri sake of say the Argentine no be officially their player when e kpuff.

The world governing body players’ status committee (PSC) rule say Cardiff must pay the money wey dey the transfer agreement and dem reject the Welsh club arguments on plenty of grounds.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

Share to...