One Hibernian fan wey provoke confront Rangers skippo James Tavernier ontop don go prison for 100 days.
Cameron Mack gree say im breach the peace charge for Easter Road for March and dem don ban am to attend any football games for 10 years.
Cameron bin run from im seat enter pitch before half-time for the 1-1 draw and e come kick the ball throway as the defender bin wan take throw-in and e come dey harrass am before police and stewards come enter the matter.
Sheriff Adrian Cottam tok say the prison sentence na the only way to carry show say society no like wetin im do join the many many gbeges wey don shel