Tori say dem don abandon Plans to play Villarreal home game against Atletico Madrid on 6 December for inside Miami.
One Spanish court don decide to say dem no go grant interim measures to take allow La Liga to stage the game as decisive case ontop the issue of matches wey dem dey hold abroad go take place for early 2020.
Tori say na the Spanish Football Association bin block the game wey dem don already plan down.
The court go make final ruling ontop whether the FA fit stop La Liga to hold any game for the US for February.
Last year Barcelona bin leave plans to play one game against Girona for Miami sake of lack of agreement.