The Naija male beach volleyball team go follow participate for the FIVB beach volleyball world tour wey go hold for inside Qatar between 12th-15th March 2019.
Na Team Naija be the only team from Africa wey go join other 36 countries for the main draw & 13 countries for the qualification draw for the four day beach volleyball tournament.
Na through wild card in preparations for ANOC Games in America this year team Nigeria bin make the Qatar male four star international beach volleyball tour.
The presido of the Nigeria Volleyball federation wey also be the chairmo of beach volleyball commission, Engineer Musa Nimrod don charge the team say make dem go make Naija and the continent of Africa proud and happy by proofing say their ranking for the continent as one of the best.
Meanwhile the coachee of the team wey be Francis Imoudu yarn say even though dis one go be Nigeria first time to participate for any FIVB beach tour, e promise say dem go make sure say dem leave their mark for the tournament.
According to Coach Imoudu “This go be the first time & na we go be the only African team for inside entry wey reach over forty countries. Dis na better privilege for the boys to show wetin dem fit do”.