As e dey so, the Afcon 2019 draws wey shele for inside Egypt put Nigeria for Group B together with Guinea, Madagascar ati Burundi.
Na two first timers dey the Super Eagles group and dis one come make am be like say na the group easy pass. But according to wetin naija coachee wey be Nnayi Ukwu Gernot Rorh yarn, e say Naija dey group wey tough wella for the 2019 Africa Cup of Nations .
Even though say naija get two Johny just come wey be Madagascar and Burundi for their group , the German believe say the Eagles get plenty work to do to carry come out of the group.
E say make anybody no write off any of Guinea, Madagascar and Burundi because for den to even qualify show say dey no be referee at all so therefore den no go use small eyes take dey look dem.
Rohr, bin dey the Egypt to use I’m korokoro eyes witness the draws wey shele for Egypt capital wey be Cairo. E Don also expose plan of the Super Eagles to rise chest against Ghana and Senegal to take prepare for the tournament proper wey go start on June 21.
Nigeria bin miss the last two editions of the African Nations Cup but qualify for the 2019 after den top Group E. The Super Eagles go begin their Afcon 2019 Waka with Kassia against Burundi on June 22 before den go come face Guinea on June 26 and Madagascar on June 30.