Italy defender wey be Giorgio Chiellini don come out to accuse and tasis Real Madrid say dem rig last year Ballon d’Or as e claim say dem stop Cristiano Ronaldo from kolobing the award.
Ronaldo bin complete im £100million waka go Juventus for 2018 summer transfer window before e come finish as runner-up for the Ballon d’Or voting for the back of Luka Modric.
Na on Monday dem bin crown Lionel Messi as dis year winner,as e kpake the ogbonge award for a record sixth time and waka pass Ronaldo kolobi of five titles.
The Portuguese star no show at all for the party wey shele for Paris as e dey house for Italy to collect im Serie A player of the year gong for the Gran Gala awards for inside Milan.
Na for the event Chiellini come para dey defend im Juventus team-mate as e claim say Real Madrid bin want make their own player win.
Even though say the Italian defender believe say Ronaldo suppose win the award last year, but e gree say Messi deserve to kpake this year own.