Bayern Munich striker Robert Lewandowski don come out again to tarsis the way im club carry do transfer business dis summer.The Bundesliga champions bin release Franck Ribery and Arjen Robben while James Rodriguez waka go back Real Madrid after im loan spell finish.
Lewandowski believe say im side need to add more attacking players since wey dem don kolobi two defenders and one forward for dis transfer window.
Bayern bin sign French defenders Benjamin Pavard and Lucas Hernandez while Robben, Ribery, Rodriguez, Mats Hummels and Rafinhacomot from the club.
E don tey wey Niko Kovac side don dey chase Manchester City winger wey be Leroy Sane but all the pursue still never get head.