Klinsmann don comot hand as Berlin coach

Klinsmann don comot hand as Berlin coach

B4 b4 USA Mens coachila wey be Jurgen Klinsmann don comot hand as Hertha Berlin short term head coach after just 10 weeks wey e bin take charge.

Na for November dem be name  the b4 Tottenham, Inter Milan and Bayern Munich striker, 55, as the club oga go reach the end of the season.

 

Hertha bin kolobi just three out of the Nine league matches when Klinsmann be dey incharge and dem dey 14thon top the Bundesliga table presently.

 

Klinsmann tok say im no fit do pass as im hand reach if im no get the trust of those wey get mouth for the club.

 

Klinsmann go now waka go back im before position ontop the club supervisory board.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
error: Content is protected !!