Four-time Grand Slam champion wey be Kim Clijsters don delay to waka come back to the WTA Tour sake of knee injury wey she get.
Clijsters tok say she no go fit compete for January as she continue her rehabilitation and treatment.
Clijsters wey first retire for 2007 to go start family say na other mothers like Serena Williams and Victoria Azarenka ginger her to wan come back.
The b4 b4 world number one bin return for 2009 come kolobi three more Grand Slams before she come retire again for the second time for 2012.
When she bin announce her latest waka come back for September, Clijsters say she dey target waka comeback for January when the 2020 season go start but add join say she no go too wahala her self as her schedule no go dey tight.
As b4 b4 world number one, Clijsters dey eligible for unlimited wildcards to play for WTA tournaments. She go need to play three tournaments or kpake 10 ranking points to take enter the ranking system.
Clijsters kpake 41 WTA titles and she spend 20 weeks as world number one for her two previous spells.