Skippo Mohammad Naveed dey among one of the three United Arab Emirates players wey dem provisionally suspend after dem charge dem under the International Cricket Council (ICC) anti-corruption code.
Naveed dey face plenty charges, including one agreement to carry fix matches for the World Twenty20 qualifiers wey dey come up.
Im Fellow seamer wey be Qadeer Ahmed don collect akpako charge with six breaches of the code while batsman Shaiman Anwar dey face two.Dem get until 30 October to respond.