Netherlands oga wey be Ronald Koeman tok say Georginio Wijnaldum bin sidon yarn with im team-mates about racism before im celebrate as e do for the 5-0 kondo akpako nacking of Estonia.
Wijnaldum and im team-mate wey be Frenkie de Jong bin point to the colour of their skin after the Liverpool star bin kolobi the first of im three goals.
E do dis one sake of the racial abuse wey Excelsior player Ahmad Mendes Moreira bin suffer for the hand of Den Bosch fans for the Dutch second tier.
Koeman tok say true true Ginibin mention something wey resemble wetin e do for the dressing room.E say Wijnaldum dey happy with the present Dutch team, where the problem of racism no dey happen.
Earlier dis week, midfielder Wijnaldum tok say wetin shele with Mendes Moreira really touch am ontop personal level.