Manchester City don escape transfer akpako ban after dem admit say dem breach Fifa rules as e take concern the signing of smallie players.
Dem don fine the Premier League champions kpogiri wey reach 370,000 Swiss Francs (£315,000).
Fifa tok say City bin breach article 19 of their regulations wey say : “Dem dey only allow International transfers of players if the player dey over the age of 18.”
City say the breaches,wey shele before December 2016,na as a result of “misinterpretation of the regulations in question”.
Chelsea bin collect akpako ban from kolobing players for two transfer windows sake of almost the same rule breach – but the club dey try appeal make dem for overturn their own too.