After the kpokporisation of Icelandic side wey be UMFÂ Selfoss, Naija Super Falcons no fit repeat the same against fellow World cup bound team wey be Canada for the Pinatar Arena women football festival as dem fall yakata 2-1 for Spain.
Tori wey dey say Canada coachee wey be Heiner-Moller happy wella say dem play Naija as dem get another African for their World cup group E wey be Cameroon and dem believe say dis na another way to carry test their strength and ready for the World cup.
As of half-time Nigeria bin dey lead with goal wey Desire Okparanozie score for the 26th Min but the Canadians come back for the second half with vexation to level up with goals from Janine Beckie(47mins) and Sophie Schmidt (53Mins) to kolobi the game 2-1.
Plenty improvements dey for the Nigerian ladies side but dem still need work to do as dem go jam tough opponents for group A that is France , Norway and South Korea.
Canada wey be number 5 for World bin start their waka against England women and dem kpokpo dem 1-0 and now dem don beat Naija 2-1 to take continue their ogbonge waka for the Pinatar Arena women football festival.
Canada go start thier world cup waka for France against No. 46 Cameroon before facing No. 19 New Zealand and the eighth-ranked Netherlands.