Dem don suspend American boxer Ryan Martin for four years sake o say e fail drugs test after im fight against Scotland boxer Josh Taylor for Glasgow.
The 26-year-old bin test positive for one substance wey dem dey call metabolites of testosterone after the fight on 3 November, 2018.
UK Anti-Doping tok say Martin suspension bin start from the date wey dem fight the fight.Martin claim say the banned substance bin dey inside the supplement wey im bin take.
Taylor bin kpake the super-lightweight fight,dis one go be Martin first loss in 23 bouts.
Last month Taylor bin kolobi the IBF, WBA and Ring Magazine world super-lightweight titles with kpake over Regis Prograis for inside London.