Chinese Grand Prix fit no hold

Ross Brawn tok say Formula 1 go try to reschedule the Chinese Grand Prix if e no go fit hold on the original date wey dem bin put  sake of the coronavirus outbreak.

The Grand Prix suppose hold for inside Shanghai on April 19  but now e be like e don enter voice mail as the disease don kpuff more than 560 people.

Brawn say dem fit postpone the race if chance dey say e no happen for  April.

Dem bin sidon yarn the matter for the meeting wey F1 strategy group of ogas and teams bin hold with no conclusion.

F1 dey wait to hear the Chinese authorities decision on top the race.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

Share to...