Tori say Chelsea dey ready to reward striker Tammy Abraham sake of the way e carry start the season and the Blues ready to double im £50,000-per-week wages for Stamford Bridge.
Chelsea bin call back the 21-year-old for summer after im loan waka with Aston Villa, and dem come sharply put am straight enter inside the senior side sake of say the club no fit sign players for the window because of the transfer ban wey dem get.
Abraham bin score im first Chelsea goals as im side kpokpo newcomers Norwich 3-2 on Saturday and e don make ogbonge strong start to the season with plenty impressive performances.