30
Tori say na b4 b4 Arsenal oga wey be Arsene Wenger be the top candidate for the Bayern Munich job after the comoting of Niko Kovac as coachee.
Bundesliga giants Bayern dey look for chacha manager after dem sack Kovac after their 5-1 akpako nacking for Eintracht Frankfurt hand last weekend.
The 70-year-old Arsene Wenger na im the Bayern hierarchy choice as dem dey look for candidate wey fit helep the club revive their season and wey go fit handle big-name players dem.
The legendary b4-Premier League oga wey sabi speak German wella never work since e pack im load comot from Arsenal for the end of the 2017-18 campaign.