E fit don reach nearly two years since Philippe Coutinho make im big gbogiri waka from Liverpool go Barcelona but the Spanish club still dey owe plenty money to the banks.
Coutinho bin waka go join the Catalan outfit for inside the deal wey tori say fit reach £142m for January, 2018.
Things no work out well for the Brazilian for the Nou Camp and so the team come send am ontop loan waka go German Champions Bayern Munich.
Tori from inside Spain tok say Barcelona annual accounts wey show how much the club dey owe others within football and for there na Liverpool own stand out.
From the original Coutinho fee, dem say e still remain £84m wey dem go pay paid.
Tori sef dey say dis outstanding debt dey related to bonuses.£24m of that amount dem consider am to dey due in the ‘short term’, although the accounts no provide any precise time-frame.