Barcelona dey vex with Ousmane Dembele after the winger no show for one medical to carry check the extent of the injury wey e bin get for the yakata falling for Athletic Bilbao hand.
Dembele bin play the whole 90 minutes for the 1-0 kondo yakata for La Liga opening fixture on Friday night, but e come be like say e no too get himself as e waka comot for pitch after the game.
As tori come dey Barcelona bin dey expect Dembele to come hospital on Saturday morning to carry check the muscle problem, but e no show until Monday.
When dem finally check-am e come show say Dembele bin suffer tear to im left hamstring and dis one now go see am out of action for five weeks.
Barcelona don already dey worry as per the 22-year-old attitude like last season. Ousmanne injury now don leave Barcelona short of attacking options dem especially as Lionel Messi and Luis Suarez no sure.