Author: Jovita Eke
D Nigeria Women Football League board pipu don come out to set deadlines for clubs to carry register for the 2018/2019 league season.
After postponement upon postponement, tori wey dey now say the Nigeria National league don shift go 3rd of April wey be Wednesday.
Naija U19 Cricket Team surprise everybody wen dem carry akpako samma host Namibia for the curtain raiser of the Africa Division 1 ICC U19 Cricket World Cup Qualifiers wey dem play for Wanderers Cricket Stadium for inside Windhoek, Namibia.
Moruf Adeyemo wey be the head coachee of Ibom Angels Football Club don come out to tok say, e sweet am with the way wey im girls take play the friend friend gbege against Abia Angels Football on Sunday.
Ibom Angels and Naija Falcons player and before before U 20 Women National team player wey be Glory Ogbonna yarn say im team dey prepare wella for the new season and say the team get new mentality now.
The Nigerian Rugby Football Federation (NRFF) and The Ghana Rugby Football Union (Ghana Rugby) Presidos wey be, Kelechukwu Mbagwu and Herbert Mensah don come out to announce the creation of one annual Presido Cup wey dem go dey play on a home-and-away basis.
With dis one wey the continent dey ready to play the final AFCON qualifiers, tori wey dey come out from inside Ghana tok say coachee Kwesi Appiah wan bring ogbonge team wey consist of foreign base players dem go play for the kasala against Kenya for the Final group F gbege wey go shele on March 22 for inside Accra. According to yarn, dis one don turn to revenge mission sake of say Kenya kpokpo the black stars 1-0 kondo for inside Nairobi last year September and as e dey so, dem ready to die there for the second…
Super Falcons player wey be Josephine Chukwunoye believe say all the preparations wey the team don do to carry ready for France 2019 go really go helep the team. E say make people no judge the team base on their waka for both China and for the Cyprus women tournament as e say room dey to improve wella, world cup still dey like 2 Months plus away. According to Jojo, the team and coaching crew dey work hard to make sure say everything dey on point before the World Cup proper for France. E say things don change for…
Naija number one tennis player Blessing Samuel don tok say dis sport wey dem dey call tennis na expensive sport e be and say person wey no dey financially capable or wey no get sponsor no go fit play am. She say tennis wey she dey play so if to say her papa no sponsor her maybe today nobody for dey hear her name. According to her, tennis na family game and she bin grow up dey see her papa dey play and just like the Williams Sisters, her papa begin dey coach her from small and naim inspire…
The Naija male beach volleyball team go follow participate for the FIVB beach volleyball world tour wey go hold for inside Qatar between 12th-15th March 2019. Na Team Naija be the only team from Africa wey go join other 36 countries for the main draw & 13 countries for the qualification draw for the four day beach volleyball tournament. Na through wild card in preparations for ANOC Games in America this year team Nigeria bin make the Qatar male four star international beach volleyball tour. The presido of the Nigeria Volleyball federation wey also be the chairmo of beach volleyball…