Author: Jovita Eke
The Super Eagles of Nigeria don crawl four places enter 42nd for the latest Fifa ranking wey the World governing join body bin release today. As e stand so Nigeria don become the third best team for Africa.
So that their waka for matches go dey go serewere and for players to gbadun their journey waka, the Ondo State Government don carry better chacha team bus samma Sunshine Stars FC players and officials dem.
Tori wey dey say LMC don carry akpako Sanctions samma Katsina United sake of say dem breach Fair Play Principles.
For inside rugby matter, Thankgod Okafor’s RC Montemor bin kpake the Portuguese second tier of rugby championship after dem kpokpo Benfica for the final.
Tori say Super Falcons of naija go jam one Icelandic club as part of their preparation for the women world cup wey go shele for inside France.
Super Falcons Assistant coachila wey be Maureen Madu don come out to tok say e totori am as player wey dey house kolobi the young player award for the award night wey dem do for inside Lagos wey Nasarawa Amazon player Anam Imo carry go house.
Aproko wey dey say the 2018/2019 Nigeria National League, wey be the NNLno go start again on Wednesday wey be the 3rd of April,2019 as dem take plan am.
Bayelsa Queens Head coachila wey be Moses Aduku tok say im dey ready to kolobi the top prize for the Maiden Pre-season tourney for women football teams for obodo Nigeria.
Tori say everything don dey set to host the second edition of the Confederation of Africa Volleyball (CAVB) Zone 3 male and female clubs championships wey dem don put down say go hold for Lagos between 14th and 19th April 2019.
Zimbabwe FA don come out to tok say one fan kpuff when crowd bin scatter dey run (oyibo dey call am stampede) outside the national stadium for Harare before their final Group G kasala against Congo-Brazzaville.