Author: Jovita Eke

Nigeria Golden Eaglets don dey Tanzania to follow take part for the 13th Africa U17 Cup of Nations wey go shele from 14th – 28th April. The team go dey look to kolobi the U17 AFCON trophy again for Dar es Salaam on 28th April wen the tournament go end.

Read More

The 2018/2019 season for the Nigeria National League(NNL) go start today wey be Wednesday 10 April 2019 for different centres wey dey pick for the biggest expanded abridged divisions dem wey dey since the history of the second tier.

Read More

With all the Racism Kasala wey don yakpa dey happen for World of football so,  b4 b4 Naija international wey be Taribo West don open mouth yarn say no be today e don dey happen,  say wen e dey playback in the days e even worse pass today.

Read More

A1 Kaduna Utd – Bye NAF FC – EFCC FC Malumfashi FC – ‘Delta Force’ (Kada City).This game is on HOLD A2 FC Taraba – Bye Kogi Utd – FC Yarmalight FC Zamfara – Jigawa Golden Stars A3 Real Stars – Bye Green Beret – Bimo Sporting Club Rarara FC – Road Safety FC A4 Giordano FC – Mighty Jets ABS FC – Sokoto Utd,this game will be played on Thursday 11/4/19 Adamawa Utd – Aklosendi International B1 Giant Brillers – Bye 3SC – Abia Comets Bayelsa Utd – Osun Utd B2 Akwa Starlets – Jossy FC of Owerri J’Atete…

Read More

After the kpokporisation of Icelandic side wey be UMF  Selfoss, Naija Super Falcons no fit repeat the same against fellow World cup bound team wey be Canada for the Pinatar Arena women football festival as dem fall yakata 2-1 for Spain. Tori wey dey say Canada coachee wey be Heiner-Moller happy wella say dem play Naija as dem get another African for their World cup group E wey be Cameroon and dem believe say dis na another way to carry test their strength and ready for the World cup. As of half-time Nigeria bin dey lead with goal…

Read More

One Hibernian fan wey provoke confront Rangers skippo James Tavernier ontop don go prison for 100 days. Cameron Mack gree say im breach the peace charge for  Easter Road for March and dem don ban am to attend any football games for 10 years. Cameron bin run from im seat enter pitch before half-time for the 1-1 draw and e come kick the ball throway as the defender bin wan take throw-in and e come dey harrass am before police and stewards come enter the matter. Sheriff Adrian Cottam tok say the prison sentence na the only…

Read More