Author: Jovita Eke
Tori say the Senegalese Football Association presido wey be Augustin Senghor don confirm say the Teranga Lions go jam the Super Eagles of Nigeria for inside friend friend game as dem dey ready for the 2019 Africa Cup of Nations for inside Egypt.
Tori say b4 b4 Brazil football Oga wey be Jose Maria Marin don collect Akpako life ban sake of say e collect kpogiri wey e no suppose collect in exchange for media and marketing rights dem.
As the draws for the Afcon 2019 don come and go so, many ex-internationals and presidos of football federations still dey yarn concerning the possible chances of some teams to shock others for the tournament wey go start for June.
Aproko wey dey say Naija international midfielder wey be John Ogu fit piante comot for Israel wen season end after e don spend five years.
Smallie Nigerian defender wey be Daniel Obi bin play im first game for Leicester City U18s as dem kpokpo over Norwich City 3-1 for one U18 Premier League match wey shele for the Leicester City Training on April 13.
Nigeria under 19 handball male team on Sunday fall yakata to Chinese Taipei for the final of the IHF International Trophy Challenge for inside Prestina, Republic of Kosovo.
Tori say the African Beach Games 2019 wey go shele for Cape Verde for June go see the first ever African Beach Games happen for the island of Sal.
Rugby Africa Presido wey be Khaled Babbou don inform Unions as per the decision wey Rugby Africa EXCO take to cancel dis year Silver Cup wey suppose shele for the Lagos Polo Club, Ikoyi for Lagos Nigeria.
As e dey so, the Afcon 2019 draws wey shele for inside Egypt put Nigeria for Group B together with Guinea, Madagascar ati Burundi.
Naija international wey be Peter Olayinka fit miss Slavia Prague waka go London next week for the second leg of their Europa League quarter final kasala with Chelsea sake of say yellow card matter.