Author: Jovita Eke
Tori wey dey say akpako don nack De Sapele Lions Football Club sake of say dem abandon their match Day 4 away fixture against Host Akwa Starlets for Uyo so dem go gat to pay kpogiri wey reach five hundred thousand naira (N500,000.00).
NNL group B1 Strugglers Osun United go welcome 3SC wey dey form for their matchday kasala for inside the Nigeria National League (NNL) for the Osogbo township stadium,dis Saturday wey dey come so.
Senegal Referee wey be Maguette Ndiaye wey dey middle for the Car confederations cup semi-final second leg Kasala between CS Sfaxien and Red Berkane don come out to you say no player/s attack am after the gbegerism finish for Morocco for weekend.
Napoli presido wey be Aurelio De Laurentiis tok say make dem stop to dey play the Champions League and Europa League.
Cameroon goalkeeper and Ajax Amsterdam goalkeeper wey be Andre Onana tok say for black goalkeepers to make am for the top of European football, dem must dey ready to work harder wella.
According to tori wey dey the Ministry of Youth and Sports don give three National Sports Federations deadlines to hole their Congress to take adopt and ratify their Constitutions dem.
Cameroon international wey be Christian Bassogog don ginger im Chinese Henan Jianye to come from back and to kpokpo Beijing Renhe 2-1 on Sunday.
Northern Conference A1 Kaduna Utd 0- 0 Kada City NAF FC ,Abuja 1- 0 Malumfashi FC Katsina A2 FC Taraba 1-1 Jigawa Golden Stars FC Yarmalight BYE A4 Giordano FC , Kano 2-2 Aklosendi Int’l of Lafia Southern Conference B1 3SC of Ibadan 3-1 Bayelsa Utd B2 Jossy Utd 1- 136 Lion of Lagos Akwa Starlets 3- 0 De Sapele Lions FC (Match reportedly abandoned on the 72minutes) J’Atete Warrior 2-1 Stationery Stores of Lagos B4 Warri Wolves 3-2 WBLC FC
Shooting Stars Sports Club (3SC) of Ibadan on Sunday at kpokporise Bayelsa United of Yenagoa 3-1 for the Lekan Salami Stadium to carry move go top of the Nigeria National League (NNL) Group B1.
Enyimba don extend their 11 games without kpokpo for the Nigeria Professional Football League (NPFL) after dem they hammer Enugu Rangers 3-1 for the Enyimba International Stadium, Aba on Sunday for their Matchday 17 fixture.