Author: Jovita Eke
After dem don sidon shok eyes think am well well concerning the official report of the rescheduled match wey dem play for inside Katsina,the NNL don make up their minds decide some things in line with vital sections of the rule book ontop assaults, encroachment, match disruption among others dem:
Nnayi Ukwu Coach Gernot Rohr Don bring out list of 25-man squad to carry ready for the 32nd Africa Cup of Nations finals for inside Egypt dis summer. Six other players dey for standby. Mikel Obi wey never play for Naija since the world cup finish bin seal im Waka come back the National team after im sidon yarn with Coach Rohr for the United Kingdom and dis one mean say e fit add join im 85 international caps. Rohr make sure say e keep the guys wey helep am kolobi the ticket enter the AFCON finals with one match…
Na Cecilia Nku, Ngozi Okobi and Captain Desire Oparanozie top the list of 27 players wey Naija Super Falcons Head Coachila Thomas Dennerby bin list for the final camp for inside Austria as preparation go continue for the 8th FIFA Women’s World Cup finals wey go shele for inside France from 7th June go reach 7th July 2019.
South Africa’s government has said it wants an appeal to be lodged against rules that force some female athletes to reduce testosterone levels.
Serena Williams don make winning return from the injury wey she get as she kpokpo Swedish qualifier Rebecca Petersen 6-4 6-2 to take advance enter the second round of the Italian Open clay-court tournament on Monday.
Na so so drama full the last day of the English premier league 2018/19 season as Pep Guardiola and Manchester City retain their title after the 4-1 kpokporisation of Brighton and Hoves Albion.
Rafael Nadal don tok one kine say im fit Waka leave tennis if im feel say im no go fit play for high level, though the world No 2 believe say im fit still kolobi more titles.
Cameroon don name 34-man provisional squad for next month Africa Cup of Nations kasala for inside Egypt.
Tori wey dey says Rugby fans wey dey around the World fit start now begin dey plan their own Olympic waka as the Organizing committee don launch the Tokyo 2020 official ticket website.
Morufu Adeyemo wey be the coachila of Ibom Angels Football Club tok say e go make sense to pick cha-cha set of future Super Falcons from the current home base Super Falcons wey dey represent for the WAFU tournament wey dey shele for inside Cote d’ Ivoire so.