Author: Jovita Eke
Tori wey dey say China Don call back b4 b4 Italy coachee wey be nnayi ukwu Marcello Lippi to come handle the country National team again.
For the first games wey dem Don play so, Colombia pour sand for the Garri of host Poland. The South Americans kpokpo dem 2-0 kindo for group A. Japan and Ecuador share draw soup 1-1, Mexico fall 2-1 give Italy.
MATCH DAY 22/22 Sunday, 26/05/19 4 pm. GROUP A: *Rivers Utd FC vs Bendel Insurance FC. *Wikki Tourist FC vs Rangers Int’l FC. *Remo Stars FC vs Lobi Stars FC. *Niger Tornadoes FC vs Kwara Utd FC. *Katsina Utd FC vs Enyimba Int’l FC. *Sunshine Stars FC vs MFM FC. GROUP B: *Yobe desert Stars FC vs Nasarawa Utd FC. *Go Round FC vs Gombe Utd FC. *Delta Force FC vs Plateau Utd FC. *Abia Warriors FC vs Kano Pillars FC. *FC Ifeanyi Ubah vs Akwa Utd FC. *Heartland FC vs El-Kanemi Warriors FC.
Tori say Nigeria Professional Football League (NPFL) Coaches, Players and Officials dem go honour late Coachila Solomon Ogbeide.
Kano Pillars Football club don book Super 6 playoff after dem kpokpo Delta Force of Asaba 3-0 kondo for the Kofar Mata stadium. Rabiu Ali bin score from penarity spot for the 19th minute before Auwalu Ali Mallam and Yusuf Maigoro come add two join for the 49th and 56th minute to tKe kolobi the game for the homers. Technical Adviser wey be Ibrahim Musa tok say na baba God make the Super 6 qualification possible and e promise say dem go deliver the league shield to the Government and the people of Kano state wey season. Meanwhile Auwalu…
Presido of the Nigeria Football Federation, Mr. Amaju Melvin Pinnick tok say the football governing join body go soon institute welfare foundation for before before Naija international players dem to take make sure say kpogiri dey on ground for them in case of unexpected health challenges as e take happen n with Chairmo Christian Chukwu. Na both the NFF presido and the 1st Vice Presido of the Confederation of African Football, give dis assurance for inside London. For the NFF Football Awards for Lagos on 1st April 2019 naim dem announce say dem go form welfare foundation for…
The matchday six of the NNL go she’ll dis weekend for all the designated centers as dem take schedule am. For the Northern Conference on Saturday 18 May,2019 e go be: A1 Standing BYE is Malumfashi FC of Katsina NAF Rockets FC vs Kada City FC Sunday 19 May,2019 Kaduna Utd vs EFCC FC A2 Saturday 18 May,2019. FC Zamfara are BYE Kogi Utd v Jigawa Golden Stars FC Taraba vs FC Yarmalight A3 BYE -Rarara FC Green Beret of Zaria vs Road Safety Real Stars of Kaduna vs Bimo SC of Abuja A4 Mighty Jets of Jos vs Adamawa…
Tori wey dey say Rugby Africa go host the Rugby Africa Women’s Cup for inside Johannesburg, South Africa for August 2019, na qualifying competition for the Women’s Rugby World Cup wey go shele for New Zealand for 2021 e be.
After Delta Queens FC no gree play the Friend friend kasala with Bayelsa Queens FC, a day before dem go gbege demselves , the Restoration Girls Don sharperly arrangee another friend friend match.
Tori wey dey say LMC don shift the Week 20 kasala for the 2018/2019 Npfl Season wey dey on so wey dey between Yobe Desert Stars fc and Kano Pillars fc wey suppose shele on Wednesday 15/5/2019 go thursday 16/5/2019.