Author: Jovita Eke
The LMC don announce the Agege Stadium Lagos as venue for the Super Six Kassia to take determine who be champion for League.
Union Berlin don kolobi promotion enter the Bundesliga for the first time for their history after dem play 0-0 draw after their relegation play-off second leg comot Stuttgart enter Bundesliga 2.
Hangover Striker and USA U-20 player wey be Soto kolobi two goals to take helep the United States to kpake important U- 20 World Cup win over Nigeria.
Barca starman wey be Lionel Messi don kolobi im number six European Golden Shoe and na the 36 La Liga goals wey e score for the Spanish Champions helep am kpake am and comot small boy wey dey play for PSG Kylian Mbappe for the setting.
B4 b4 Naija international wey be Victor Moses kolobi one goal as Fenerbahce kpokpo Antalyaspor 3-1 for one Turkey Super Lig kasala on Sunday.
Tori say Ghanaians dey para sake of say Bernard Terkpetey name no follow for Ghana squad wey dey go the 2019 AFCON as dem don enter social media begin dey tarsis and question coachee Kwasi Appiah to come explain give dem why the striker no dey list.
Dis na the 23 Super Falcons players wey go represent for the 8TH FIFA WORLD CUP FINALS.
Nigeria today start their waka for the 22nd FIFA U-20 world cup for inside Poland ontop good note as dem kpokpo Qatar 4-0 kondo for their opening kasala for the tournament.
Tori wey dey say Ghana Don sharply go kolobi two technical experts wey be Jermaine Lopia and Simon Copley from Manchester City and Arsenal respectively on top short term basis to helep the team ready for the Africa Cup of Nations finals wey dey come so.
As the countdown and preparations continue for the Womens world Cup for inside France, the Cameroon women’s national team no dey play at all as dem carry better Akpako 4-0 kindo take Samma Levante for the friend friend gbege wey dem play for the Pinatar Arena.