Author: Jovita Eke
Tori say dem don release the Confederation of African Football (CAF) Presido wey be Ahmad without any charge after dem ask am questions wey concern one corruption shook eye.
Tori say Neymar no go play for the Copa America after e wound for ankle for Brazil friend friend gbege with Qatar.
Aproko wey dey say the Cameroon Football Federation (Fecafoot) wan send delegates go jam with Liverpool and indomitable Lions player Joel Matip and follow am yarn unto coming back to the team to helep dem go defend their title for the Nation’s Cup for Egypt.
Tori wey dey say the Confederation of African Football don decide say Espérance Sportive de Tunis and Wydad Athletic Club – WAC go replay the CAF Champions League Final 2nd Leg fixture.
Gbegerism to take determine who kpake league don start today for Agege Stadium Lagos as Enugu Rangers wey dey group A of the Super six fall yakata 1-0 kondoto Entombed FC, Kano Pillars and Akwa United come play 2-2 draw while Ifeanyi Ubah fall 3-1 to Lobi Stars.
United States Don carry better shock give France for the Under-20 World Cup wey dey shele for inside Poland.
Tori wey dey on ground say Cuban mixed martial artist, former freestyle wrestler and UFC fighter wey be Yoel Romero don kolobi $27.45 million for a lawsuit against one supplement company.
After the 4-1 Yakata falling of Arsenal for the Europa League Final against Chelsea, b4 b4 Gunners midfielder wey be Cesc Fabregas Don para provoke for Gunners German playmaker wey be Mesut Ozil.
B4 b4 Rangers international players Don come out to hail the Seven-time Nigeria league champions and reigning FA cup champions wey be Rangers International F.C sake of say dem kolobi ticket for the end of season Super-Six playoff.
Tori say the skippos of the 16 teams wey go compete for the HSBC London Sevens jam for Kensington Palace as den dey ready for the round of the HSBC World Rugby Sevens Series 2019.