Author: Jovita Eke
Tori from inside Spain tok say Luis Enrique don comot hand say e no dey do again as Spain coach because of one serious family problem.
Egypt Skippo wey be Ahmed Elmohamady don hail teammate Mohamed Salah before im country Africa Cup of Nations (Afcon) opener against Zimbabwe on June 21.
Ghana striker wey be Asamoah Gyan believe say dem ready for the Africa Cup of Nations after dem draw 0-0 with South Africa the friend friend gbege wey shele on Saturday.
Moussa Wague don come out to yarn say im go continue to dey work hard as im dey try kolobi regular spot for Barcelona first-team wen next season go come.
Nigeria don fall yakata three places go 45th position for the latest rankings wey the International Federation of Association Football (Fifa) bin release. Dis announcement shock many people as the Super Eagles bin move up go four places for the rankings for April. Super Eagles don play friend friend gbege against Zimbabwe as part of their preparation for the 2019 Africa Cup of Nations (Afcon)but e end for goalless draw for inside Asaba. The Super Eagles dey among the African teams wey drop very low for the latest rankings, dem join Guinea, DR Congo, Lesotho and Seychelles as the African…
Scotland dey face big task to qualify for the knockout stages of the World Cup as dem lose their second 2-1 game give Japan dis Friday.
Tori say Real Madrid don kolobi Japanese teenager Takefusa Kubo as dem describe am as one of the most promising ogbonge young players for world. The Japanese midfielder go join Real Madrid Castilla wey be the club reserve team. Kubo wey be 18 years dey international duty with Japan for the Copa America and e make im international debut on June 9 against El Salvador.E don play 13 times for FC Tokyo for 2019, kolobing four goals. Aproko from Spain say Madrid go pay Japanese top-flight side FC Tokyo 2m euros (£1.78m) for the smallie player.Kubo bin dey Barcelona book…
Organisers tok say dem don invite Caster Semenya to come run for the 800m for Sunday Diamond League Meeting for Rabat.
Algeria don call Montpellier striker Andy Delort to take replace Haris Belkebla wey Coach Djamel Belmadi bin drop sake of say e misbehave.
Manchester City midfielder Bernardo Silva tok say im support the introduction of the video assistamnt referee VAR as im believe say e go helep referees improve the game with stronger decisions.