Author: Jovita Eke
Kenyan defender wey be Eric Ouma yarn say Harambee Stars go dey move forward dey go after the Africa Cup of Nations (Afcon) experience wey dem get.
UEFA dey consider to protect teams wey reach the closing stages of the Champions League as dem assurance dem spot for the next season competition.
Democratic Republic of Congo manager wey be Florent Ibenge tok say im team bin face some kine issues before their Africa Cup of Nations gbege against Zimbabwe, wey wan scatter their chances to carry succeed.
FC Porto Goalkeeper Iker Casillas don come back for pre-season training for Porto just two months after im suffer heart attack.
Antonio Valencia don waka comot Manchester United after 10-years and e don return back to im country Ecuador to sign for Liga Deportiva Universitaria.
Atletico Madrid dey plan to move for Real Madrid floppy wey be James Rodriguez. Dem don link the Colombian playmaker name with waka go Napoli but Atletico say dem ready to give am chance to stay for the Spanish capital.
Current Wimbledon champion wey be Angelique Kerber don waka enter the semi-finals of the Eastbourne after e kpokpo Romania Simona Halep for straight sets.
American Cori Gauff don become the youngest player wey go qualify for the main Wimbledon draw since the Open era start for 1968 for the age of 15 years and 122 days.
Presido of the Guinea Football Federation (FGF) wey be Antonio Souare, don charge the national team say make dem do everything wey be say dem fit to kpokpo Nigeria, as dem dey target chance for the final of the 2019 Africa Cup of Nations.
Tori say Chelsea get reach the June 30 to take kolobi Real Madrid midfielder wey be Mateo Kovacic.