Author: Jovita Eke
Tori say Nabil Fekir fit still waka comot Lyon but the Ligue 1 club no go allow any other player comot sake of say some don already waka. Talented left-back Ferland Mendy and star midfielder Tanguy Ndombele don waka go Real Madrid and Tottenham respectively, while the club dey plan to enter the chacha 2019-20 season with chacha head coachee Sylvinho. Juninho Pernambucano just dey settle as director of football and the Brazilian dey determined to prevent any comotting of talent. That one mean say Memphis Depay, Moussa Dembele and Houssem Aouar go keep their load and…
Algeria go get plenty supporters and fans wey tanda gidigba for their back wen dem go gbege Nigeria for Sunday Africa Cup of Nations semi-final kasala. The North Africans dey try reach their first final in 29 years but before dem go fit do that one dem gat to waka pass Genort Rohr men for inside Cairo Stadium on Sunday. Long ago , na Nigeria Algeria kpokpo to take kolobi their only Afcon title for 1990. Tori wey dey say Algerian Ministry of Defence go use six military planes to take carry supporters and Ten Air Algeria planes go deliver…
Napoli head coachee wey be Carlo Ancelotti get hope say James Rodriguez go sign for the Series A club dis summer.
Referee Roddy Zambrano wey be the man wey dey middle for the Copa America semi-final kasala between Brazil and Argentina Don come out to carry explain some kine decisions wey im bin take for the gbege after Messi come out to tarsis the way im take perform.
According to wetin sporting director Leonardo tok, Kylian Mbappe na top priority for Paris Saint-Germain, even though say the Brazilian no believe say im dey any position to promise club supporters say their smallie star go stay for Paris.
With the way wey Benin carry comot Morocco from the Afcon round of 16 , Senegal midfielder Henri Saivet believe say Benin go hard to play when dem go jam for the quarter-final of the 2019 Africa Cup of Nations on Wednesday.
Liverpool Ogbonge player Mohamed Salah don come out to apologise give fans and supporters of Egypt after their comoting for the Africa Cup of Nations.
After Lionel Messi open mouth to tarsis Organizers say dem bin set up the Copa America for BRazil to kolobi , na so Selecao coachila wey be Tite don provoke come out to para for the Barcelona Star say e need to show respect and gree say dem beat am instead of to dey yarn apata anyhow. Messi dey when Argentina bin lose give Brazil for the semi-finals, before Refree come giam Red card for the kasala against Chile for the third-place play-off, Messi bin suggest say the Officials dey favour the host wey be Brazil throughout. True…
Real Madrid don send smallie Martin Odegaard out ontop loan waka again go Real Sociedad for the 2019-20 season. The Spanish giants don confirm the news and dis one go be Odegaard third loan waka for Madrid since im waka come the club for 2015. Since im move four years ago, Odegaard don go loan waka for Heerenveen, before e come spend small time for fellow Dutch side Vitesse. Odegaard bin join the Spanish giants as one of the hottest talents wey dey the world football and many bin dey expect am to blow but e no gree blow. Na…
Ghana striker Asamoah Gyan say time never reach to begin dey tok about the black stars kolobing the Africa Cup of Nations (Afcon) trophy for Egypt as dem dey ready to play Tunisia for the Round of 16 on Monday.