Fighter Reza Madadi tok say im wan break the taboo of Iranians fighting Israelis after e go come out of retirement to carry gbege Moshe Ben Shimol for one unofficial exhibition bout for inside Stockholm for November.
Jovita Eke
American teenager Coco Gauff dey ready to break enter inside the worlds top 100 for the first time after she reach her maiden WTA Tour quarter-final.
Boxer Oleksandr Usyk first bout for the heavyweight division don enter on chance after Saturday opponent Tyrone Spong bin return an adverse doping test meaning say dem bin find some kine prohibited substances for im system na so promoter Eddie Hearn.
Simone Biles don brake the record for World Gymnastics Championships medals wey any woman don win as she kolobi her 21st medal as the USA kpake their fifth straight team title.
B4 b4 Cameroon coachila Clarence Seedorf and im assistant wey be Patrick Kluivert dey demand for $8 million from Cameroon as dem tok say dem pursue dem unfairly from their work.
Barcelona still dey owe Liverpool almost two years after dem sign Coutinho
E fit don reach nearly two years since Philippe Coutinho make im big gbogiri waka from Liverpool go Barcelona but the Spanish club still dey owe plenty money to the banks.
England Women coachila wey be Phil Neville don gree say four yakata falling for five matches dey unacceptable but say im get confido for the work wey im dey do with the squad.
Christian Pulisic don come out to tok say im bin dey frustrated sake of say im no dey get chance play for Chelsea dis season but say im go try build ontop im ogbonge performance wey e perform afetr e come from the bench against Southampton.
Manchester City manager Pep Guardiola say im dey sure say im current assistant wey be Mikel Arteta go succeed am for the future.
Rugby Defending champions we be New Zealand play better rugby to carry kpokpo South Africa for their World Cup Pool B opener for Yokohama.