Author: Jovita Eke

B4 b4 boxing heavyweight champion wey be Tyson Fury tok say im dey seriously consider to fiht one fight for MMA before the year go end and im say im dey look to the sport biggest star wey be Irishman Conor McGregor to helep train am for im first fight.

Read More

French midfielder Franck Ribery don come outside to apologise sake of say e provoke vex come push one assistant referee and dis one come make am collect red card, after Fiorentina 2-1 yakata falling to Lazio.

Read More

Tiger Woods tok say im waka come back to full fitness dey go tuele tuele and say e even fit return before time sef as e dey recover from the knee operation wey e do.

Read More

Tori say dem don give American boxer Eric Molina additional one-month ban sake of say e breach the terms of im two-year suspension for failing one doping test.

Read More

Tori say one football agent wey dem accuse of corruption don come out to claim say b4 b4 Manchester United Coach wey be Sir Alex Ferguson bin conspire to fix one match between Manchester United and Juventus and e bin collect Rolex gift watch wey reach £30,000, na so one court hear today.

Read More