Tori say Nottingham Forest and Olympiakos owner wey be Evangelos Marinakis don test positive for coronavirus.
Marinakis, 52, bin dey for the City Ground for Forest Championship fixture against Millwall on Friday.
Olympiakos bin dey ready to host Wolves for the Europa League on Thursday, although tori say Wolves don beg say make dem postpone the kasala.
Tori say wen e bin stay for inside Nottingham e no show show any symptoms of the virus.
The club don dey ask advice from medical professionals and the relevant governing join bodies dem to carry make sure say dem take the correct measures dem.
Earlier before, Marinakis don go ontop im social media platorm to take announcement say dem don diagnose am with coronavirus.