Tori say Police for inside Paraguay don hold b4 b4 Brazil forward wey be Ronaldinho sake of say e use fake passport take enter the country.
Aproko say Police bin search one hotel wey dey the capital wey be Asuncion on Wednesday, where the star bin dey stay with im brother.
Paraguay interior minister tok say the brothers bo dey under arrest but say dem just dey under shook eyes.
Minister Euclides Acevedo also yarn say dem say their hand dey clean as dem no do anything wrong and say Ronaldinho and im brother dey co-operating with the authorities.
For Inside July 2019,authorities dem bin seize the player Brazilian and Spanish passports sake of say e no pay im taxes.