Tori say the WBC don formally reinstate British heavyweight boxer wey be Dillian Whyte as the mandatory challenger for Deontay Wilder World Boxing Council world heavyweight title.
Dis one come after dem drop Whyte doping violation charge. Na for June e bin provide one sample wey contained traces of one steriod wey dem don ban but UK Anti-Doping don withdraw the charge as dem say the levels dey very low.
Whyte now fit fight the person wey go win from the Wilder versus Tyson Fury bout.That gbege dey ready to shele for February 2020 for inside America. and the WBC dey tok say Whyte go fight for one world title for the first time on or about February of 2021.