Everton dey expect Everton midfielder Andre Gomes to recover wella after e do operation to take repair the fracture dislocation wey e get for im right ankle.
The 26-year-old Portugal international bin suffer the wound for im side Sunday 1-1 draw with Tottenham.One club statement tok say the operation wey shele on Monday go extremely well.
Gomes go dey hospital to recover before e go come start im rehabilitation under the guidance and shook eye of Everton medical staff.
Cenk Tosun wey kpake Everton 97th-minute equaliser tok say im team players nearly cry for the dressing room after the game finish.