Japan world number four for tennis wey be Naomi Osaka yarn say she dey dey very comfortable anytime wey she play ontop courts wey dey hard.
Osaka, 21, dey gbadun her strong run of form for the Pan Pacific Open for her home city as she reach the final agter she kpokpo Belgium Elise Mertens, 23.
The two-time Grand Slam winner waka pass Mertens 6-4 6-1 for her second game after she comot Kazakhstan Yulia Putintseva for setting with a 6-4 6-4 akpako nacking .
The reigning Australian Open champion go now play Russia Anastasia Pavlyuchenkova for the final, after the 28-year-old kpai Germany Angelique Kerber 6-3 6-3 for the other semi-final.