Tori say Nigeria dey try convince Chelsea striker Tammy Abraham to forget England and represent the Super Eagles for international level.
After Odion Ighalo hang boot after the Africa Cup of Nations finish, Nigeria dey use hot eyes dey find better striker.
Abraham wey dem born for Camberwell bin make im England debut for one friend friend kasala over Germany for November 2017 before e come appear against Brazil one week later but e dey free to switch allegiance since e never play any compettive match for Gareth Southgate side.
The striker don make strong start to the season for Chelsea, e get four goals for six games.
Abraham also get 25 caps for England Under-21s, e score nine goals for that level.