Toronto FC center-back Chris Mavinga bin get road accident after im team play 2-2 draw against Columbus Crew.
Mavinga bin play the whole 90 minutes for the Mapfre Stadium for Saturday Major League Soccer outing.
Few hours after,na so the 28-year-old come announcement say him and him family get accident and e get wound.
The b4 b4 Rubin Kazan defender bin enter social media to share video of where the crash happen and e don carry advice give people say make dem dey try reduce their driving speed.
Mavinga club never come out to tok whether the wound serious or not but im dey hope to come back in time for Toronto next league kasala against Montreal Impact on Sunday.