With the way wey Benin carry comot Morocco from the Afcon round of 16 , Senegal midfielder Henri Saivet believe say Benin go hard to play when dem go jam for the quarter-final of the 2019 Africa Cup of Nations on Wednesday.
The Squirrels bin qualify for the knockout stage as one of the best third-place teams after dem draw Ghana 2-2, come play goalless with Guinea-Bissau and champions Cameroon.
Benin no waste time at all as dem comot Morocco for the Round of 16, dem comot the North Africans after dem play penarity shoot-out after the normal time bin end 1-1 to take reach the last eight of the competition for the first time for their history.
Senegal meanwhile kolobi their place for the quarter-final after edem kpokpo Uganda 1-0 kondo for the Cairo International Stadium on Wednesday.
Saviet don play for all but one of Senagal last four games,don carry warning give im side of the danger wey Benin fit pose against the Teranga Lions.
Senegal bin fall comot for the quarter-final of the 2017 Africa Cup of Nations and dem go dey hope say e no go repeat again on Wednesday.