Liverpool Ogbonge player Mohamed Salah don come out to apologise give fans and supporters of Egypt after their comoting for the Africa Cup of Nations.
The Pharaohs bin fall yakata 1-0 kondo to South Africa on Saturday after Thembinkosi Lorch score goal on the 85th minute. Already many feel say the host country na one of the favourites to kolobi the trophy , the fans shock when dem fall yakata comot for the hand of South Africa.
As e dey so Egypt gat to wait for another long time before dem go fit kolobi their eighth Afcon crown, and first since 2010.
Egypt no waste time at all after dem fall comot for the Afcin as dem sharperly nack both Javier Aguirre and im coaching staff akpako sack.
Even Egyptian Football Association (EFA) Presido wey be Hany Abou-Rida also respect imself and jejely step down after Saturday defeat.