Arsenal player Mesut Ozil don marry im Fiancee wey be Amine Gulse for Istanbul and na Turkey Presido Erdogan be im Best Man.
The German star wey get Turkish root bin to provoke fans with im legberious waka for the Europa League and now e don cause another wahala with dis latest matter.
Fans no happy at all and dem don enter inside social media to tok their mind concerning the presido invitation.
Mesut Ozil wey comot hand for the national team sake of tarsis say e take photo with the Turkey presido bin invite Recep Tayyip Erdogan and im wife Emine as honorary guests as im marry tey tey girlfriend wey be former Miss Turkey.
Ozil public support for the Turkey presido don affect the course of im career. Dem born Mesut for Germany to one Turkish family.The whole gbege start wen Ozil and Ilkay Gündogan, another German player wey get Turkey blood bin face public anger for May 2018, after dem jam with Erdogan come give am jersey join .
Many people including the German Football Federation (DFB) and im presido wey be Richard Grindel, claim say dem bin get hand for im “election campaign stunt” after photo of the meeting go public.
Ozil later come out to deny am say nothing like politics for the picture say na just to demonstrate respect for where im come from.
But as e dey so Ozil no send wetin anybody tok by im action for im wedding as e make sure say Erdogan full ground.